Connect with us
Categories:
X

ANE Stories

[STORY] ADVENTURES OF BIG T (Final Episode 13)

Published

on

Share this post:

ADVENTURES OF BIG T

Episode 13 (Last Episode).

‘Hon. Osusu Jeremiah Desmond wants to see you’ as the chick take relate with me. My mind shock as if I hug transformer, the person wey won see me na confirm person for we country. Na eem be the most richest man for Africa, him surname dey for every sector of business wey dey exist. I just chill as I take ask the chicks why him won see me. ‘Well, he wants to have a conversation with you’ as the chick dey yarn. Me no get wetin I dey do, na were he con dey make I go meet am. ‘We would take you there as the chick dey yarn. Me just enter motor…
*******************

As me dey inside motor, dey flex big time. My mind con dey play better track wey the moment need as I dey nod my head …am boss…Rick Ross_Boss…
The journey be like Isrealite’s journey because of the hold up, hmmm! The go slow fit make person, buy pure water take use brush teeth, then put motor for reverse, dey waka go work back. I happy as we reach Victoria Island, ee take us 15 minutes drive to Banana Island. The place wey we dey go na Amara Suite. See building, my mouth drop water.
*******************

…As I sight Hon. Osusu Jeremiah Desmond, he just stand shake me, omo boy…I don turn ambassador, my body just dey sweet me like dog wey see him owner. “Its good to see you Big t” Hon. Osusu Jeremiah Desmond dey yarn. My Oga at the Top, your boy loyal oo. “Well, I have gone through your profile and I would appreciate you working for me” Hon. Osusu Jeremiah Desmond dey yarn. *i no get anything to say, as I dey look like JJC* “take this file, inside it contains the information about the nature of the job” Hon. Osusu Jeremiah Desmond dey yarn.. Na so I take collect am, me look am well well, plenty english full inside,but everything sweet me, na to just be him P.A and that’s all. Na so me take sign the file. “Its glad to have you on my side. I got some special benefits for you” Hon. Osusu Jeremiah Desmond dey yarn. Na wetin be dat My Oga at the Top. “Since the moment you singed that contract, your 96 million naira rich, I got you a new three bedroom water front flat plus a boys quater, located in Banana Island. Your new ride would be sent to you on monday” Hon. Osusu Jeremiah Desmond dey yarn. I be dey expect make he tell me April Fool, hmmm! Dat one small, I be one faint, no na wetin I go do na to happy… “This is a file contains everything you need to know”Hon. Osusu Jeremiah Desmond dey yarn. Na where my office con dey. “Don’t worry about that your office, it would get to you and I have a flight to catch, perhaps your yoruba love is looking for you right now Hon. Osusu Jeremiah Desmond dey yarn. Na so he waka go, see escorts,money good oo
*******************

….I just waka go Irumole place, he get one secret thing wey I want make he do for me. Our talk tey small as I give am money take execute am. Me con go my babe side, she con dey form vex for me. “You did not bother calling me at all, that your going out” Seyi dey yarn. Wetin self, I buy something for you. “What’s that”. Seyi dey yarn as she dey curious dey look my hand. Na chocolate I buy for you, this one na special one because dem carve your name put…I be one fall for ground as she jump put for my body.
*******************

Morning reach, my head dey read meter sake of say na my yoruba love birthday. She just dey act normal, me no even bother to tell her happy birthday. I con go check Baba Ijebu result, my eyes fall out as I no tell any body say my game drop. I go Ojota go collect my money cash 240000 naira. I call Irumole to check my plans, he say tins dey waka well. Na so I go meet my yoruba love back….Baby na clubbing things for you oo, so ready make we commot.
*******************
*as evening knack, sun no get mind again, lizard done hide and wall gecko don show face, cricket dey play music, mosquito dey dance, rat dey do vigilante, cockroach dey form wings*

…….Na so me wear my confirm cloth, but warri no dey carry last, my yoruba love be like wetin dey use jazz take fine every day. The way she package, I need to put tag for her body, make another man no go snatch her from me. Me con stop taxi wey go carry us go the place, I be Big T so I no need to talk price wit the driver, as he push us reach the place.

See levels wen we step enter the Pheelz Bar, the music stop…..Happy Birthday To You…My yoruba love no con know wetin to do as she first give me better kiss based on say na all her friends dey the party. Hahaha me burst smile in warri because I never finish. I signal Irumole for next thing as….na so Chris Daniel come out dash…..’no be you I carry come but na you I go carry come but na you I go carry go sisi agbaribo eya owe’ *everybody just dey groove…..the party waka well but Big T head must gum wall like cement for the party.

Na eem D.J stop music for me to do my thing, as everybody circle us. Me con yarn dem sam I get one better gift for my babe, na so I tell my babe make she close eyes and face back. Me con wear her one chain wey her name dey dere. As she open eyes look back, she just shock….*kneel down with one leg*…my yoruba love na your face I want to dey wake up see every morning….na you I want make my pikin call mama…na you I wan dey with till I puff…oyibo don plenty…abeg say you go marry me… “What took you so long, yes I will” Seyi dey yarn
– THE END


Get More Stories Like This On: Facebook: @AllNaijaEntertainment, Twitter: @AllNaijaEntertainment
Click to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Black and White French Bulldog puppies Frenchie Joy
Lifestyle2 days ago

Black and White French Bulldog puppies Frenchie Joy

3 Serious Reasons to Keep Your Teenager Away From Social Media
Lifestyle2 weeks ago

3 Serious Reasons to Keep Your Teenager Away From Social Media

Boxing vs MMA What Makes Them So Different
Sports4 weeks ago

Boxing vs MMA: What Makes Them So Different

Roisea: Most Advanced Crypto Trading Platform for Bitcoin
Technology4 weeks ago

NFTs and Intellectual Property Rights: Shaping Creative Ownership

The Birth of a Rugby Nation South Africas Love Affair with the Sport
Sports5 months ago

The Birth of a Rugby Nation: South Africa’s Love Affair with the Sport

A Beginner's Guide to Radicle (RAD): The Future of Peer-to-Peer Development
Technology6 months ago

A Beginner’s Guide to Radicle (RAD): The Future of Peer-to-Peer Development

Analysis of Nigeria's Renewable Energy Sector: Opportunities and Challenges
Technology7 months ago

Analysis of Nigeria’s Renewable Energy Sector: Opportunities and Challenges

Casino Gaming Poker
Sports7 months ago

What Are The Various Types Of Online Slots?

Luka Modric celebrates after scoring Real Madrid's second goal against Celta Vigo.
Sports8 months ago

Luka Modric set to join Ronaldo in Saudi Arabia’s Al Nassr

WHO World Health Organization
Health8 months ago

WHO debunks claims that tuberculosis is caused by witchcraft, poison

Atiku Abubakar
News8 months ago

2023 Election: Why DSS must arrest Fani-Kayode – Atiku

PDP Logo Umbrella
News8 months ago

PDP suspends National Chairman

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories8 months ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Final Episode 13)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories9 months ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 12)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories9 months ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 11)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories9 months ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 10)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories9 months ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 09)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories9 months ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 08)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories9 months ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 07)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories9 months ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 06)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories9 months ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 05)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories9 months ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 04)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories9 months ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 03)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories9 months ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 02)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories9 months ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 01)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories9 months ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Complete Episodes)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories9 months ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 16)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories9 months ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 15)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories9 months ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 14)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories9 months ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 13)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories9 months ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 12)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories9 months ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 11)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories9 months ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 10)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories9 months ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 09)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories9 months ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 08)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories9 months ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 07)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories9 months ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 06)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories9 months ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 05)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories9 months ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 04)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories9 months ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 03)

ANE Billboard Hots