Connect with us
X
Categories:

ANE Stories

[STORY] ADVENTURES OF BIG T (Episode 11)

Published

on

Share this post:

ADVENTURES OF BIG T

Epsiode 11.

…As I waka enter my yoruba love house na so nepa bring light, me just drive my body go bathroom so I fit wash away my sorrow. Omo see que for there, hmmmm! Ee remain small make I ask Whether them dey share money for the bathroom. The person wey dey bathroom no gree come out and no water sound self, as I won para, na so I see 1000 naira for ground, see me see better.

Me just shadow con watch before I go pick am, nobody even notice am. I just waka near the money, me won pick am na so person pass, I just put leg on top, con dey sing …emi lo ba se, na me be king kong…. *Vector – king kong*. ‘Bross say you never ready to bath, na your turn oo’ na so one babe like dat yarn me. Abeg no worry, you fit go bath because I never ready. Plenty time waka, me still dey dat spot as people tey clear comot, me done know say time done reach to do Western Union Money Transfer from ground to my pocket. I con bend down pick the money, na so I hear PAA!, na person knack my hand. Fear catch me like the one wey EFCC dey catch person, me con look up. Na so me hear, ‘say na your own oga Big T’ na one small boy just relay words give me. No vex I be won use finger print take find the owner before, me just carry my head put for ground, as I waka carry my bucket enter bathroom, with confirm ELA!! and shame.
*******************

Me just carry strong face enter my yoruba love room, me chook leg enter inside, na so I sight wetin fit make hungry hala MIA *Missing in Action*. Table done set, na confirm semolina, the wey the packaging be, I fit tell say na semolina and no be semovita. The soup na dat kind wey go make you wet as in your tongue, na better bitter leaf soup with cat fish wey still fresh and my one bottle of origin con top am. ….as I chop finish, my body be like say no be me get am, na so I struggle enter bed, me greet my yoruba love good night and warn her say I won crash and make she no disturb me, sake of say I won dream better 2sure wey I go knack for Baba Ijebu for morning.
*******************

*D.J Tenniebenson_me and my guys oh, say we go sing song, say we go live long* The D.J just scratch that song as me and my guys dem enter the club. Na big time party things for us, we just collect centre table, na so we order for posy*na wheel barrow wey different type of drinks dey and na 1 million be the price*. For the table so na me Big T, Charlywizzy, Escaysegzy, Simzy, Doozie, Okklad, Scholesjnr, Khola, Stanny, we dey flex better. Me con sight won babe wey done dey look me since, na eem I waka go meet her, after plenty talk we con enter room. As the babe pull cloth, my spartacus almost tear my boxer, me just chill as a guy man wey I be. The babe just near me, as I done off load my clothes, she just bend down put my joystick for mouth, my head ring alarm. I done almost release na so person just bang the door open, me won stone the person slap, why na that crucial moment the door go open. As I look person wey stand for door na My Yoruba Love, na eem me burst window come out, na so I wake up…

…As me open eyes, na eem I just gum bed, see wetin I see, my yoruba love just serious dey suck my d*ck, her bobby con dey swing go up and down like jagilova. Next thing I just hear…”Baby, hope I did not disturb your sleep” na Seyi dey yarn. No na, you even helep me turn am to reality. Me con shoot everything wey dey my d*ck enter her mouth, as she take swallow am but stain am small for face like pikin wey dem feed akamu. Me con put dics two, as I dey un top her, me con kiss her as if tomorrow no dey before I enter her b*east. As I put finger inside her p*ssy na, so she shout ‘baby faster’ me na boos for the matter, as she take cum, all her body con weak. Me con put my Spartacus inside her, me rock am well well, until shoot another load like cannon for inside her p*ssy. Na so we just hold each other wen sleep con carry us go.
*******************

I still dey un top bed dey cruze sleep, as nepa no gree take light, so the fan dey sama my body well. Na so person take peck me for face, me open one eye, na my yoruba love dey my front. She done dress up already like person wey won comot. Na so she tell me ‘baby sorry to wake you up, am going out to meet a client to collect her measurement and some other stuffs’ Seyi dey yarn. Ok I done hear you. ‘…and I dropped 5000 naira on the table for you to use and please don’t stay out too late’ Seyi dey yarn.
*******************

Today na me go run this town, their fada, warri!!!. Na so I burst enter street, with no direction. Me con see one poster of Scales__Man of the Year_album, me con fall enter the shop, as I take buy two copies. The money wey my yoruba love give must yield something, I con waka go one Baba Ijebu kiosk so . Me check game wey dey play na Gold, hmmm me con collect chart take forecast better solid two sure. I con tell the person wey dey terminal say make he fire 02*39 for me and make he press am 1000 naira.

…. As I dey stroll dey waka about like Johnny Walker, na so two black Toyota Amanda park for my front, the motor be like wetin never touch ground before, them tint the motor black. As me con stand for one conner dey view the motor like say I never see motor before. Na two fine chicks con come down from each of the motor, oboiy!!! See assets them carry oo, them even wear black suit, if Will Smith even see them, na then he go use take act ‘Women on Black. As I done tire to look, me con press forward, na so person say ‘please, excuse me Big T’.

Na. Normal tin for person wey popular like me but when I look back, na those chicks call my name. As I look back, I con dey feel like. 2baba, maybe dem mistake call me, na so me con press forward dey go house. Na eem I hear am again as them take waka near me. “Its you Big T we are calling” as the chicks near were I dey. Na me be this oo, wetin una dey find, abi una done miss road. ‘Not. At all, we have a message for you’ as one for the chick follow me yarn. Na wetin con be the message so. ‘Hon. Osusu Jeremiah Desmond wants to see you’.
To Be Continued….. . . .


Get More Stories Like This On: Facebook: @AllNaijaEntertainment, Twitter: @AllNaijaEntertainment
Click to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Diya Can't Have Enough G-Wills
Music3 days ago

[Music] Diya – “Can’t Have Enough” Feat G-Wills

Email Newsletter Marketing Online Website
Technology1 week ago

The Vital Role of Email Fraud Detection Software

Roisea: Most Advanced Crypto Trading Platform for Bitcoin
Business3 weeks ago

The Role of Regulation in Crypto Investment: Navigating Legal Frameworks

Volatility in Commodities and How to Deal with It
Business1 month ago

Volatility in Commodities and How to Deal with It

Expanding Living Space
Lifestyle3 months ago

Expanding Living Space: Prefabricated Workshop Building Kits for Extra Rooms

BeBe Winans
Lyrics4 months ago

BeBe Winans – It All Comes Down to Love [Lyrics]

BeBe Winans
Music4 months ago

[Music] BeBe Winans – It All Comes Down to Love

The Countdown Begins to the Tournament That Has It All
ANE Football Analytical4 months ago

AFCON 2023: A Sporting Spectacle Set to Captivate the World

Litecoin: What Makes It The Crypto Winner?
Technology5 months ago

Runny Inflation Can Drive Cryptocurrency Adoption

Black and White French Bulldog puppies Frenchie Joy
Lifestyle5 months ago

Black and White French Bulldog puppies Frenchie Joy

3 Serious Reasons to Keep Your Teenager Away From Social Media
Lifestyle6 months ago

3 Serious Reasons to Keep Your Teenager Away From Social Media

Boxing vs MMA What Makes Them So Different
Sports6 months ago

Boxing vs MMA: What Makes Them So Different

Roisea: Most Advanced Crypto Trading Platform for Bitcoin
Technology6 months ago

NFTs and Intellectual Property Rights: Shaping Creative Ownership

The Birth of a Rugby Nation South Africas Love Affair with the Sport
Sports10 months ago

The Birth of a Rugby Nation: South Africa’s Love Affair with the Sport

A Beginner's Guide to Radicle (RAD): The Future of Peer-to-Peer Development
Technology11 months ago

A Beginner’s Guide to Radicle (RAD): The Future of Peer-to-Peer Development

Analysis of Nigeria's Renewable Energy Sector: Opportunities and Challenges
Technology12 months ago

Analysis of Nigeria’s Renewable Energy Sector: Opportunities and Challenges

Casino Gaming Poker
Sports1 year ago

What Are The Various Types Of Online Slots?

Luka Modric celebrates after scoring Real Madrid's second goal against Celta Vigo.
Sports1 year ago

Luka Modric set to join Ronaldo in Saudi Arabia’s Al Nassr

WHO World Health Organization
Health1 year ago

WHO debunks claims that tuberculosis is caused by witchcraft, poison

Atiku Abubakar
News1 year ago

2023 Election: Why DSS must arrest Fani-Kayode – Atiku

PDP Logo Umbrella
News1 year ago

PDP suspends National Chairman

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Final Episode 13)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 12)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 11)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 10)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 09)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 08)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 07)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 06)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 05)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 04)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 03)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 02)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 01)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Complete Episodes)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories1 year ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 16)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories1 year ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 15)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories1 year ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 14)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories1 year ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 13)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories1 year ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 12)

ANE Billboard Hots