Connect with us
X
Categories:

ANE Stories

[STORY] ADVENTURES OF BIG T (Episode 10)

Published

on

Share this post:

ADVENTURES OF BIG T

Episode 10.

MR. Awotunde just enter the room with two gun for him hand, as he take sit down for chair wey face me and my yoruba love. Hmmmmmmm! My mind fly con lost like Malaysia plane, that cold wey dey make person update weather for two catch me. Me no even know how the thing they do me, I need to chop better liver, dat kind one wey Mama Chika dey sell or else my matter go turn Story for the Gods. “We meet again, but this time in a decisive moment” Mr. Awotunde dey yarn. Na so we see am *Seyi just gum for my back*.

“I have an offer for you, this is something that would change your life” Mr. Awotunde dey yarn. Na wetin be the thing. “I want you to join my team, bring justice to its call” Mr. Awotunde dey yarn. Dat one no fit happen, I be one man mopol. “Well this is the opportunity……” Mr. Awotunde dey yarn. I no let am talk finish because plenty talk no they full basket. Na so I quickly shoot am before he go think about am, na there I know say na only me waka come. My gun just sound fiak!, bullet done finish oooo. “I told you before, you won’t see it coming” Mr. Awotunde dey yarn. Na so he take shot me with the gun wey dey him hand, na eem me self fall go ground.
*******************

My body won peel, as I fast remove the bullet proof wey save me. I use eye find Seyi, I no even see her, even Mr. Awotunde. I con run go outside, as I take see as motor wey them they. I con pick two gun for ground, as I pursue the motor with my leg, na eem I con reach were my power bike dey. Me just tear speed as if na Etisalat Easy Blaze I subscribe. I burst enter express as I take they fire pursue them.

I divert go left this man block, I follow the other side na still the same thing. Na so I vex turn Ghost Rider, as I put speed wey na only one tire I stand with. The skills wey I do, make me pass am go far and I dey sure say he no see me again. Me con face am they drive come back as I hold my two gun for hand, na so I take shoot the two front tire at once. But na God save am because he don already slow down na so he crash go one side of the road. Me just waka reach were he dey, as I come down from the power bike.

I just reach there, I open door con give blow for head na eem he take catch my hand, as he take knack am for staring, he still con punch me for belle as, I fall go back. Na eem we take position like say na May weather vs Manny Pacquaio. The punch no be here as we take dey exchange am with flash share, he give me and I give am. Body no need to remember wetin ee dey collect, as I take dive am go ground. Me just dey untop the man dey pound am with blow as is na akpu, na so he take something take knack me,n I no know wetin be the thing as I take fall comot for him body. The next thing wey I see na the man carry gun face me, as I look left and right nothing wey I fit use take save my self. Na so my dream won take come thru, me just say my last prayer as I close eyes…POH!!!!!!!
*******************

… I check my body bullet no touch, oo! I don turn superman. Me con look up the man just fall go one side, na my yoruba love I see wey stand with gun. Her body dey shake, na so I waka go meet her. “Ololu fe mi, mo ti pa eyan *my love I don pia person*” Seyi dey yarn. No na, you just save my life. She just dey cry, me con pet am as she take climb my power bike, we con zoom comot.

Wen we reach na her place we go straight. My mind just dey sweet me like pikin wey dem dash packet of sugar lick, as I done reach there, see as people just dey hail me…BIG_T!…BIG_T!!…BIG_T!!!…my head just dey swell as if na me go rescue those missing girls. Me just go collect better bathing as I run go make call… Hello mummy. “Hello, have been hoping to see you ever since” mummy dey yarn. Abeg no vex for me, how my old boy body. “Well, we are lucky, he is still here with us, just taking few medications and then he would be discharged” mummy dey yarn. No worry me go come house soon. Me just dey happy say everything turn out well and thanks to my behind the scene guys and my yoruba love. As I waka enter my house na so nepa bring light…
To Be Continued…. . . 


Get More Stories Like This On: Facebook: @AllNaijaEntertainment, Twitter: @AllNaijaEntertainment
Click to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Roisea: Most Advanced Crypto Trading Platform for Bitcoin
Business1 week ago

The Role of Regulation in Crypto Investment: Navigating Legal Frameworks

Volatility in Commodities and How to Deal with It
Business3 weeks ago

Volatility in Commodities and How to Deal with It

Expanding Living Space
Lifestyle3 months ago

Expanding Living Space: Prefabricated Workshop Building Kits for Extra Rooms

BeBe Winans
Lyrics3 months ago

BeBe Winans – It All Comes Down to Love [Lyrics]

BeBe Winans
Music3 months ago

[Music] BeBe Winans – It All Comes Down to Love

The Countdown Begins to the Tournament That Has It All
ANE Football Analytical3 months ago

AFCON 2023: A Sporting Spectacle Set to Captivate the World

Litecoin: What Makes It The Crypto Winner?
Technology4 months ago

Runny Inflation Can Drive Cryptocurrency Adoption

Black and White French Bulldog puppies Frenchie Joy
Lifestyle5 months ago

Black and White French Bulldog puppies Frenchie Joy

3 Serious Reasons to Keep Your Teenager Away From Social Media
Lifestyle5 months ago

3 Serious Reasons to Keep Your Teenager Away From Social Media

Boxing vs MMA What Makes Them So Different
Sports6 months ago

Boxing vs MMA: What Makes Them So Different

Roisea: Most Advanced Crypto Trading Platform for Bitcoin
Technology6 months ago

NFTs and Intellectual Property Rights: Shaping Creative Ownership

The Birth of a Rugby Nation South Africas Love Affair with the Sport
Sports10 months ago

The Birth of a Rugby Nation: South Africa’s Love Affair with the Sport

A Beginner's Guide to Radicle (RAD): The Future of Peer-to-Peer Development
Technology11 months ago

A Beginner’s Guide to Radicle (RAD): The Future of Peer-to-Peer Development

Analysis of Nigeria's Renewable Energy Sector: Opportunities and Challenges
Technology11 months ago

Analysis of Nigeria’s Renewable Energy Sector: Opportunities and Challenges

Casino Gaming Poker
Sports12 months ago

What Are The Various Types Of Online Slots?

Luka Modric celebrates after scoring Real Madrid's second goal against Celta Vigo.
Sports1 year ago

Luka Modric set to join Ronaldo in Saudi Arabia’s Al Nassr

WHO World Health Organization
Health1 year ago

WHO debunks claims that tuberculosis is caused by witchcraft, poison

Atiku Abubakar
News1 year ago

2023 Election: Why DSS must arrest Fani-Kayode – Atiku

PDP Logo Umbrella
News1 year ago

PDP suspends National Chairman

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Final Episode 13)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 12)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 11)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 10)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 09)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 08)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 07)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 06)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 05)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 04)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 03)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 02)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 01)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Complete Episodes)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories1 year ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 16)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories1 year ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 15)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories1 year ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 14)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories1 year ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 13)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories1 year ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 12)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories1 year ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 11)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories1 year ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 10)

ANE Billboard Hots