Connect with us
X
Categories:

ANE Stories

[STORY] ADVENTURES OF BIG T (Episode 09)

Published

on

Share this post:

ADVENTURES OF BIG T

Episode 09.

As I land like pilot wey no get parachute, me just enter ghost mode *dem no dey see me*. I just bend down near one tank like dat, so dat me go fit use eye take sample the area, the place be like one abandoned duplex. My mind dey read many things, because I just dey wonder why I enter this kind gbege! and matter con dey hard. But man na man, me no go relent, I must do wetin I fit do to save my Yoruba love. Na so I sight two men, them carry gun and them be like soldier ant wey dey duty, from were I dey I just calculate my steps well, as I take wear my gun eem condom *silencer*. Me gum wall, like wall gecko, con waka small small reach were dem dey, na so I shoot the first one for head, before word fall from the other one mouth, him too collect him share. I con move their body put for conner, con search around, I no even hear any voice, the place be like grave yard.

I hold my gun well, me con open the door wey remote person enter the house. As I chook head enter the house, na so I hear gboa! for my head, my head read star like Tom and Jerry, I dey sure coco go grow come out. As I get my self, my gun done enter under one chair and the silencer don divorce my gun, this one na big f*ck up ooo. Me con look up, na so I see person wey grab like Davido bouncer, con carry waist as if na Johnny Bravo. Before I know wetin dey sup, the guy carry chair won still knack me, na so I bend down take give am elbow for leg and con role comot from there. I con stand up, as I near am make I dash am my fist, na so I recive my own first for waist and chest, na blood turn close-up for my mouth, as my body shout ‘over load’. Na eem me con give am three round of blow for him body, the man no even shake at all, he just do like say he put foam for body. Na den I know say ee don red for me, I just waka dive am, the mumu follow me too dey run, for my mind I won do wetin Jet Lee dey do for film. I just count three legs for wall, con do back fleet take go the man back, as he look back I done already hold my gun. Na so I give bullet for body but he con dey do like Robocop, as he still dey struggle dey waka come my side, na so I give am last card, finishing for him head and con hala ‘check up’, as he take fall go ground.

The gun wey I shoot that time done wake people wey dey the house, as I dey smile say I don fall Goliath, na eem bullet fly pass me. I no even bother to look back, as ijump for the back of one big chair, the chair role go back as the chair turn shield. The shooting be like were compound to compound dey use banger fight, the chair wey I dey done dey bring smoke come out. As I look na five people I see, them done stop to they shoot, two of them done they waka dey come my side. Na so I use my Bullet Messenger *gun* take shoot them for chest, na eem I waka comot from that place. Na so one near me, as the man shoot, I just rush bend down give upper cut, as I take hold am for neck, con use the man as shield wen him fellow people dey shoot me, the man be like better brother keeper as he help me collect all the bullet for body. I just give the remain two better head shot, as them touch ground.

I search all the rooms I no dey see any sign of Seyi, my mind done over think wen I open the last door I just see her. I just stand like those three Eko statue wey dey hail you welcome to Lagos, na BOMB dey my yoruba love body. I waka near her, as I comot the celletape wey dey her mouth. “Baby please don’t touch it’ Seyi dey yarn. *her eyes done soak with pipe borne water*. I no talk anything as I waka go find phone, I collect one from one man like dat wen don puff. I dial Ufousky number, the thing say *the number your trying to call is incorrect, please check the number and dail again*, my mind fly, I try another one before the number con go, na so he carry phone.

“Hello, who’s on phone” Ufousky dey yarn. Na me Big T. “You never die, abeg the motor still dey if na wetin you want be that” Ufousky dey yarn. Abeg I wan make you help me diffuse one bomb wey dey my girl body *na so I describe am the type of bomb for am*. “Ok take better deep breathe” Ufousky dey yarn. I do do am. “Good, na how many wire you dey sight” Ufousky dey yarn. The wire many ooo. “Omo see gobe, na how many red dey there” Ufousky dey yarn. Na only one dey here. “Say you get anything wey you fit use take cut am” Ufousky dey yarn. Yes oo, small knife dey my hand. “Cut the red one, and tell me wetin happen” Ufousky dey yarn. Hmmmmmm I still dey alive and the time stop con start again. “Ok, na how many minute remain” Ufousky dey yarn. Na 45 seconds. “Once the time knack 20 seconds, cut the green one” Ufousky dey yarn. Ok I done hear oo*23….22…..21…….baby I love you……..20* hello Ufousky you still dey dere because the time done stop. “Great job! Abeg go update ur status for Facebook say you done disable bomb. You do well for me no worry I go use number as phone a friend for ‘Who Want To Be a Millionaire.

As me just comot the bomb from my yoruba love chest, na so my yoruba love hug me as if super glue dey between us. I con notice say person dey waka enter the room through the mirror wey dey the room. Na Fumnanya, as I wan turn back na so she shoot, but me just push my girl fall as I take pull two bullet for her chest. She just fall go ground, me con dey happy. Na eem MR. Awotunde just enter the room with two gun for him hand, as he take…
To Be Continued…. . . .


Get More Stories Like This On: Facebook: @AllNaijaEntertainment, Twitter: @AllNaijaEntertainment
Click to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Diya Can't Have Enough G-Wills
Music3 days ago

[Music] Diya – “Can’t Have Enough” Feat G-Wills

Email Newsletter Marketing Online Website
Technology1 week ago

The Vital Role of Email Fraud Detection Software

Roisea: Most Advanced Crypto Trading Platform for Bitcoin
Business3 weeks ago

The Role of Regulation in Crypto Investment: Navigating Legal Frameworks

Volatility in Commodities and How to Deal with It
Business1 month ago

Volatility in Commodities and How to Deal with It

Expanding Living Space
Lifestyle3 months ago

Expanding Living Space: Prefabricated Workshop Building Kits for Extra Rooms

BeBe Winans
Lyrics4 months ago

BeBe Winans – It All Comes Down to Love [Lyrics]

BeBe Winans
Music4 months ago

[Music] BeBe Winans – It All Comes Down to Love

The Countdown Begins to the Tournament That Has It All
ANE Football Analytical4 months ago

AFCON 2023: A Sporting Spectacle Set to Captivate the World

Litecoin: What Makes It The Crypto Winner?
Technology5 months ago

Runny Inflation Can Drive Cryptocurrency Adoption

Black and White French Bulldog puppies Frenchie Joy
Lifestyle5 months ago

Black and White French Bulldog puppies Frenchie Joy

3 Serious Reasons to Keep Your Teenager Away From Social Media
Lifestyle6 months ago

3 Serious Reasons to Keep Your Teenager Away From Social Media

Boxing vs MMA What Makes Them So Different
Sports6 months ago

Boxing vs MMA: What Makes Them So Different

Roisea: Most Advanced Crypto Trading Platform for Bitcoin
Technology6 months ago

NFTs and Intellectual Property Rights: Shaping Creative Ownership

The Birth of a Rugby Nation South Africas Love Affair with the Sport
Sports10 months ago

The Birth of a Rugby Nation: South Africa’s Love Affair with the Sport

A Beginner's Guide to Radicle (RAD): The Future of Peer-to-Peer Development
Technology11 months ago

A Beginner’s Guide to Radicle (RAD): The Future of Peer-to-Peer Development

Analysis of Nigeria's Renewable Energy Sector: Opportunities and Challenges
Technology12 months ago

Analysis of Nigeria’s Renewable Energy Sector: Opportunities and Challenges

Casino Gaming Poker
Sports1 year ago

What Are The Various Types Of Online Slots?

Luka Modric celebrates after scoring Real Madrid's second goal against Celta Vigo.
Sports1 year ago

Luka Modric set to join Ronaldo in Saudi Arabia’s Al Nassr

WHO World Health Organization
Health1 year ago

WHO debunks claims that tuberculosis is caused by witchcraft, poison

Atiku Abubakar
News1 year ago

2023 Election: Why DSS must arrest Fani-Kayode – Atiku

PDP Logo Umbrella
News1 year ago

PDP suspends National Chairman

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Final Episode 13)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 12)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 11)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 10)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 09)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 08)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 07)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 06)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 05)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 04)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 03)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 02)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 01)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Complete Episodes)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories1 year ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 16)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories1 year ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 15)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories1 year ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 14)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories1 year ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 13)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories1 year ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 12)

ANE Billboard Hots