Connect with us
X
Categories:

ANE Stories

[STORY] ADVENTURES OF BIG T (Episode 06)

Published

on

Share this post:

ADVENTURES OF BIG T

Episode 06.
Na so I take jump comot for bed, my body dey shake like earth worm wey dem pour salt. I no believe say na dream I dey because everything wey happen be like real life. I thank God oo say na dream. As I look time, na so I see 07:43 AM dey knack, see kasala don burst, how I wan take reach work on time today and my Oga wan see me

… As I manage reach my work place, I go meet Ifetola Gold wey deliver message give me, say where oga dey. “He’s inside the office, probably waiting for you” Ifetola Gold dey yarn. You do well, as I match reach the door, my heart dey drop sound like Mastercraft beat *one producer like dat*, because this my oga na Mr. Awotunde and na person wey I done see once or twice before and any time wey he show face na something wan happen. ‘Good morning sir’ na so I greet am before he look back.

“What took you so long to get to me” Mr. Awotunde dey yarn. ‘Hmmm I be dey…’ *the words no gree comot oo*. “Well take this letter” Mr. Awotunde dey yarn. Thank you sir, as take I collect the letter from him hand. “the letter is to inform you that your service is no longer needed in this organization hence forth” Mr. Awotunde dey yarn. I no even shake, as if I be dey expect am and on top I be Big T, I go survive na time ee go take. Na so I stone everybody for work place the news, the thing affect them like fuel subsidy but them no fit do anything.

I con call my yoruba love say I won see her and I dey come her area where she dey work as fashion designer for one plaza like dat, say make we meet for one eatery wey near her.

… I dey for the eatery, dey flex my origin as I dey watch ’30 Days in Atlanta’, my belle won burst with laugh wen AY say ‘their father! no sorry na oyibo land we dey, their dad!, their dad!’. As I sight Seyi *my yoruba love*, my eyes almost turn opolo eyes. The way she package, as if na miss naija dem won crown, my mind settle so tey I no remember my problems again. Na so our body join together. “Ololu fe mi, ki lo shele *my love wetin happen*” Seyi dey yarn. Na just small thing oo, how work na. “Fine dear” Seyi dey yarn. Make you no vex say I dey disturb you oo. “Not at all” Seyi dey yarn. Say you remember yawa wey gas, dat day wey you come my place. “Yes I do, what about it” Seyi dey yarn. I dream am oo, say dem con kill me. “God forbid, such would never occur to you” Seyi dey yarn. That one self dey one conner, dem done even sack me for work *na so she hold my two hands, as water comot from her eyes*. “Am not happy about all this trials your facing, am with you till the end and what are you going to do now” Seyi dey yarn. I won go see my parent first thing tomorrow. “Ok dear that’s good, I got something for your mom”Seyi dey yarn. …. As I waka go her store, she give 12 yards of wrapper and one bead wey. Wey make noise before I get my self say I done think go.

********my journey waka well, as I take reach my parent side. Everybody just dey hail me Big T! Big T! Big T, dat one small self, wen all the aged people con dey do twitter role call #see_Big_T_of_yesterday_don_grow_oh. I manage reach house my family dey around, we story well. As I take give my mummy the gift wey Seyi send for her, she pray for her. The part wey sweet me pass na wen my mummy make me believe say ‘there is no place like home’, na so she sama me better pounded yam with banga soup followed by jack *the dog wey dey our compound*, them slaughter the dog because of me, I con dey feel like prodigal son wey return.

Night reach me and my guys them, they flex for we area, as time to sleep reach, me just bath and I con talk to my yoruba love phone. Me enter my room, so I fit enjoy better sleep for once, na so I see one letter on top my bed. The letter get one kind blood like logo for body, when I open am I just …
To Be Continued….. . . .


Get More Stories Like This On: Facebook: @AllNaijaEntertainment, Twitter: @AllNaijaEntertainment
Click to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Diya Can't Have Enough G-Wills
Music4 days ago

[Music] Diya – “Can’t Have Enough” Feat G-Wills

Email Newsletter Marketing Online Website
Technology2 weeks ago

The Vital Role of Email Fraud Detection Software

Roisea: Most Advanced Crypto Trading Platform for Bitcoin
Business3 weeks ago

The Role of Regulation in Crypto Investment: Navigating Legal Frameworks

Volatility in Commodities and How to Deal with It
Business1 month ago

Volatility in Commodities and How to Deal with It

Expanding Living Space
Lifestyle3 months ago

Expanding Living Space: Prefabricated Workshop Building Kits for Extra Rooms

BeBe Winans
Lyrics4 months ago

BeBe Winans – It All Comes Down to Love [Lyrics]

BeBe Winans
Music4 months ago

[Music] BeBe Winans – It All Comes Down to Love

The Countdown Begins to the Tournament That Has It All
ANE Football Analytical4 months ago

AFCON 2023: A Sporting Spectacle Set to Captivate the World

Litecoin: What Makes It The Crypto Winner?
Technology5 months ago

Runny Inflation Can Drive Cryptocurrency Adoption

Black and White French Bulldog puppies Frenchie Joy
Lifestyle5 months ago

Black and White French Bulldog puppies Frenchie Joy

3 Serious Reasons to Keep Your Teenager Away From Social Media
Lifestyle6 months ago

3 Serious Reasons to Keep Your Teenager Away From Social Media

Boxing vs MMA What Makes Them So Different
Sports6 months ago

Boxing vs MMA: What Makes Them So Different

Roisea: Most Advanced Crypto Trading Platform for Bitcoin
Technology6 months ago

NFTs and Intellectual Property Rights: Shaping Creative Ownership

The Birth of a Rugby Nation South Africas Love Affair with the Sport
Sports10 months ago

The Birth of a Rugby Nation: South Africa’s Love Affair with the Sport

A Beginner's Guide to Radicle (RAD): The Future of Peer-to-Peer Development
Technology11 months ago

A Beginner’s Guide to Radicle (RAD): The Future of Peer-to-Peer Development

Analysis of Nigeria's Renewable Energy Sector: Opportunities and Challenges
Technology12 months ago

Analysis of Nigeria’s Renewable Energy Sector: Opportunities and Challenges

Casino Gaming Poker
Sports1 year ago

What Are The Various Types Of Online Slots?

Luka Modric celebrates after scoring Real Madrid's second goal against Celta Vigo.
Sports1 year ago

Luka Modric set to join Ronaldo in Saudi Arabia’s Al Nassr

WHO World Health Organization
Health1 year ago

WHO debunks claims that tuberculosis is caused by witchcraft, poison

Atiku Abubakar
News1 year ago

2023 Election: Why DSS must arrest Fani-Kayode – Atiku

PDP Logo Umbrella
News1 year ago

PDP suspends National Chairman

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Final Episode 13)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 12)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 11)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 10)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 09)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 08)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 07)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 06)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 05)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 04)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 03)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 02)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 01)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Complete Episodes)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories1 year ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 16)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories1 year ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 15)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories1 year ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 14)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories1 year ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 13)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories1 year ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 12)

ANE Billboard Hots