Connect with us
X
Categories:

ANE Stories

[STORY] ADVENTURES OF BIG T (Episode 03)

Published

on

Share this post:

ADVENTURES OF BIG T

Episode 03.

…see blood don full my body and I con dey wonder why I no feel any pain, na so person fall down for my side. See big time falling hand, dis men no know say my cloth done stain. Dem no need to tell blind man say market dey catch fire, na so I push the big table take cover the same minute wey I hear the gun shot,, as I con use eyes take survey the people wey dey spray bullet. Na just three guys wey were mask as one waka near us shout say make we submit our property one after the other.

Na eem Irumole con won stand up, I just tell am make ee cool down watch film wey won happen. Next tin I just say my last prayer for planet earth and I con carry two star empty bottle con still mark those strong men positions, con wear the hand glove wey I dey use for work wey dey my pocket. I waka small small reach were one dey just jump use the two bottle take clap am for head before he sample me him gun he don reach ground already, before the second one face me I done stone am the two broken bottle wey dey my hand one bottle catch am for chest while the second one meet am for lap na so ee carry ground sit down dey shout like goat wey dem chook knife for neck.

Na so I pick the first guy gun, I con dive enter gutter, the last guy just dey wonder wen Jet Lee or say na Jackie Chan start to dey ack Nollywood, he just stand numb dey spray bullet for the gutter were I dey like small pikin wey dem dash new toy gun. Me done already crawl follow the gutter path take find the safest root because the last guy done dey reach were I dey. As I wan come out of the gutter na so the last guy point the gun for my neck, I nearly piss for body but dat one no move me because Irumole self dey point the guy gun for neck. Na so my advantage con advance go stage two like say na Contra I dey play, me self con come face am with the guy as police con surround us.

Big T! Big T!! Big T!!! Turn music for my ear like say GLO pay Psquare make them release song wey carry Big T as for advert for them. The people they hail my name after we settle matter with the police finish. Na him me self turn Robin Hood for the area my talk dey everywhere.

…. As Irumole drop me for front of my compound with one of him ride Accord ‘Deadly Virus 2015 model ‘. Me greet am bye bye sake on say him bab e dey with am he no con branch enter my place. Any which way na way, as I cheek my phone missed call be like 2go credit for my phone Seyi don give 27 missed calls, Fumnanya too miss self, she even send me text say I no try at all say I no fit to call am since morning join some other irrelevant calls. My body dey smell like deady body wey dem no embalm because that gutter wen I dive enter be like succer way pit.
Me dey step leg for compound like army wey return back from war, na so all the certified amebo con ask “kilo she le” *na wetin happen*. Me just dey story dem better lie, wey dey sweet them for ear na. Next tin wey I feel na person wey squeeze my ear “o mo pe wa ko ko de le no” *you no know say you suppose reach house first* Seyi dey yarn. She no even mind the wey I dey smell like aboki perfume wey sour, she hug me tight me no even care na so I hold am join body too. I con carry her go my room.

As I enter my room every where change, ee just be like say dem pimp my room, no dirty all my cloth them done already iron am, no dirty at all, well ee no concern me but the one wey move me na the aroma wey dey erupt my nose. My yoruba love say you carry party food come put for my room. “Ra ra oo moti se oje ka le fun ee but wa ko ko lo we ke to ma jeun*not at all I done cook food wait for you but you go bath first before you eat*” Seyi dey yarn. Ok I done hear oya sereve the food down make I go bath. As I dey enter my room see wetin dey table, ee be like this my yoruba love they skype me for where she be dey, na the perfect combination be this wey I go enjoy.

Amala with Ewedu and cat fish with my drink Origin two bottle and maltina na so I sit down, kiss her first, con tell her say she be better love and con tell am those sweet words wey dey make her ear ring. Me won start to dey chop na so I hear Por! Por! Por! Na who con be dis person wey no fit allow me chop first as I open the door I wan ….
To Be Continued…. . . .


Get More Stories Like This On: Facebook: @AllNaijaEntertainment, Twitter: @AllNaijaEntertainment
Click to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Diya Can't Have Enough G-Wills
Music3 days ago

[Music] Diya – “Can’t Have Enough” Feat G-Wills

Email Newsletter Marketing Online Website
Technology1 week ago

The Vital Role of Email Fraud Detection Software

Roisea: Most Advanced Crypto Trading Platform for Bitcoin
Business3 weeks ago

The Role of Regulation in Crypto Investment: Navigating Legal Frameworks

Volatility in Commodities and How to Deal with It
Business1 month ago

Volatility in Commodities and How to Deal with It

Expanding Living Space
Lifestyle3 months ago

Expanding Living Space: Prefabricated Workshop Building Kits for Extra Rooms

BeBe Winans
Lyrics4 months ago

BeBe Winans – It All Comes Down to Love [Lyrics]

BeBe Winans
Music4 months ago

[Music] BeBe Winans – It All Comes Down to Love

The Countdown Begins to the Tournament That Has It All
ANE Football Analytical4 months ago

AFCON 2023: A Sporting Spectacle Set to Captivate the World

Litecoin: What Makes It The Crypto Winner?
Technology5 months ago

Runny Inflation Can Drive Cryptocurrency Adoption

Black and White French Bulldog puppies Frenchie Joy
Lifestyle5 months ago

Black and White French Bulldog puppies Frenchie Joy

3 Serious Reasons to Keep Your Teenager Away From Social Media
Lifestyle6 months ago

3 Serious Reasons to Keep Your Teenager Away From Social Media

Boxing vs MMA What Makes Them So Different
Sports6 months ago

Boxing vs MMA: What Makes Them So Different

Roisea: Most Advanced Crypto Trading Platform for Bitcoin
Technology6 months ago

NFTs and Intellectual Property Rights: Shaping Creative Ownership

The Birth of a Rugby Nation South Africas Love Affair with the Sport
Sports10 months ago

The Birth of a Rugby Nation: South Africa’s Love Affair with the Sport

A Beginner's Guide to Radicle (RAD): The Future of Peer-to-Peer Development
Technology11 months ago

A Beginner’s Guide to Radicle (RAD): The Future of Peer-to-Peer Development

Analysis of Nigeria's Renewable Energy Sector: Opportunities and Challenges
Technology12 months ago

Analysis of Nigeria’s Renewable Energy Sector: Opportunities and Challenges

Casino Gaming Poker
Sports1 year ago

What Are The Various Types Of Online Slots?

Luka Modric celebrates after scoring Real Madrid's second goal against Celta Vigo.
Sports1 year ago

Luka Modric set to join Ronaldo in Saudi Arabia’s Al Nassr

WHO World Health Organization
Health1 year ago

WHO debunks claims that tuberculosis is caused by witchcraft, poison

Atiku Abubakar
News1 year ago

2023 Election: Why DSS must arrest Fani-Kayode – Atiku

PDP Logo Umbrella
News1 year ago

PDP suspends National Chairman

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Final Episode 13)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 12)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 11)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 10)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 09)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 08)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 07)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 06)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 05)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 04)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 03)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 02)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 01)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Complete Episodes)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories1 year ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 16)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories1 year ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 15)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories1 year ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 14)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories1 year ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 13)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories1 year ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 12)

ANE Billboard Hots