Connect with us
X
Categories:

ANE Stories

[STORY] ADVENTURES OF BIG T (Episode 02)

Published

on

Share this post:

ADVENTURES OF BIG T

Episode 02.
Hmmmmmmm my body freeze wen I see who open the door. I just stand still like dat horse wey dey front of union bank, na Fumnanya oo, see as she just dey shine like 100 watt bulb. My eyes scan am from head reach ground as if na virus scan no difference with her and coke bottle.

Next tin wey I feel na hand wey touch me “Big T good evening and please come inside” Fumnanya dey yarn. I step inside I no even sight oga landlord for the palour. “He is coming he went to take his bath” Fumnanya dey yarn. So na who oga landlord be to you. “Well he is my uncle, I came to spend the semester break in his place” Fumnanya dey yarn. Na which school you dey. “Am a student of Osusu Private University, studying Astronomy, currently in my third year” Fumnanya dey yarn.

“Big T ba wo ni, ma bi nu pe mo da e duru *how you dey no vex say I make you dey wait*. Dat room wey you book for before done dey vacant oo, if you done ready I go discount am for you” baba landlord dey yarn. I don hear baba landlord if I don ready I go come see you, good night oo. See this man, na dis useless tin ee call me for or na bad thing say I pack go my own house for Banana island. As I dey waka go my room Na eem I hear ‘Big T’ as I be dey expect before na fine anty dey call me. Me an Fumnanya con sit down for stair case, relate well oo until mosquito carry gallon dey hala fresh blood na so we path way.

Morning no dey tey reach oo, today wey be saturday I no get tins to do na eem I call my yoruba love ‘Seyi’ ask her how she dey and tell am were I drop key in case she no meet me for house. Na tym to do wetin I sabi do well oo for were we people dey read newspaper for morning. See argument wey dey drop like misseles wey dem target. This Mr. Damian na football fanatic oo, ee know inside out even the match wey no concern am. Based on Chelsea win na eem men con dey rant, boil, talk tins wey fit happen n tins wey no fit.

This hot afternoon better no gree come, na eem I carry phone take ring Andrew aka Irumole, Irumole na my personal padi wey sabi d way, de only student wey carry first class Accounting and Finance for him set join Masters in Womanology and no dey carry last for any matter wey carry the #BIG_T. Guy how far na, you no be confirm again oo. “Abeg Big T no vex oo I get pile of work wey nail me down for office” Andrew dey yarn. Ok I don hear, na were you dey self. “I dey for Mama Gbenga Store with that chick wey I yarn you about last time” Andrew dey yarn. No let the babe escape because I dey come there now.

…Irumole! Irumole! Irumole! How far na. Big T I loyal oh, fine girl I greet you oh. Good evening I’m Bellastone by name. Na beta tin say I know you, my guy na confirm oo I trust am reach ground and abeg make you no take am play. “Sure I won’t” Bellastone dey yarn. Na so I stone words enter Irumole head, guy this your girl dey bring smoke oo na dis type of girl dey make everybody hail you for road, na beta eye you get. “You know the matter now” Andrew dey yarn. Gbenga abeg sample me two alomo bitters and one bottle water make I drink. Me con dey yarn Irumole tins wit him babe na so matter con enter Fumnanya based on who Irumole be, he give me better tips take catch the girl.

As the talk dey sweet, my phone con bleep twice, chia this wicked flash wey no fit show for MTN call history, as I check am na my yoruba love. I con call her back she tell me say she dey my place already say make I waka dey come fast. Me just wan put the last particles wey setle down for my alomo bitter bottle wen I hear POO! POO! POO! Na gun shot be dat oo next thing wey I see blood don full my body….
To Be Continued…… . . .


Get More Stories Like This On: Facebook: @AllNaijaEntertainment, Twitter: @AllNaijaEntertainment
Click to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Diya Can't Have Enough G-Wills
Music3 days ago

[Music] Diya – “Can’t Have Enough” Feat G-Wills

Email Newsletter Marketing Online Website
Technology1 week ago

The Vital Role of Email Fraud Detection Software

Roisea: Most Advanced Crypto Trading Platform for Bitcoin
Business3 weeks ago

The Role of Regulation in Crypto Investment: Navigating Legal Frameworks

Volatility in Commodities and How to Deal with It
Business1 month ago

Volatility in Commodities and How to Deal with It

Expanding Living Space
Lifestyle3 months ago

Expanding Living Space: Prefabricated Workshop Building Kits for Extra Rooms

BeBe Winans
Lyrics4 months ago

BeBe Winans – It All Comes Down to Love [Lyrics]

BeBe Winans
Music4 months ago

[Music] BeBe Winans – It All Comes Down to Love

The Countdown Begins to the Tournament That Has It All
ANE Football Analytical4 months ago

AFCON 2023: A Sporting Spectacle Set to Captivate the World

Litecoin: What Makes It The Crypto Winner?
Technology5 months ago

Runny Inflation Can Drive Cryptocurrency Adoption

Black and White French Bulldog puppies Frenchie Joy
Lifestyle5 months ago

Black and White French Bulldog puppies Frenchie Joy

3 Serious Reasons to Keep Your Teenager Away From Social Media
Lifestyle5 months ago

3 Serious Reasons to Keep Your Teenager Away From Social Media

Boxing vs MMA What Makes Them So Different
Sports6 months ago

Boxing vs MMA: What Makes Them So Different

Roisea: Most Advanced Crypto Trading Platform for Bitcoin
Technology6 months ago

NFTs and Intellectual Property Rights: Shaping Creative Ownership

The Birth of a Rugby Nation South Africas Love Affair with the Sport
Sports10 months ago

The Birth of a Rugby Nation: South Africa’s Love Affair with the Sport

A Beginner's Guide to Radicle (RAD): The Future of Peer-to-Peer Development
Technology11 months ago

A Beginner’s Guide to Radicle (RAD): The Future of Peer-to-Peer Development

Analysis of Nigeria's Renewable Energy Sector: Opportunities and Challenges
Technology12 months ago

Analysis of Nigeria’s Renewable Energy Sector: Opportunities and Challenges

Casino Gaming Poker
Sports1 year ago

What Are The Various Types Of Online Slots?

Luka Modric celebrates after scoring Real Madrid's second goal against Celta Vigo.
Sports1 year ago

Luka Modric set to join Ronaldo in Saudi Arabia’s Al Nassr

WHO World Health Organization
Health1 year ago

WHO debunks claims that tuberculosis is caused by witchcraft, poison

Atiku Abubakar
News1 year ago

2023 Election: Why DSS must arrest Fani-Kayode – Atiku

PDP Logo Umbrella
News1 year ago

PDP suspends National Chairman

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Final Episode 13)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 12)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 11)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 10)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 09)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 08)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 07)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 06)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 05)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 04)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 03)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 02)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Episode 01)

The Pastor Daughter Story by Miriam Edem _ ANE Story
ANE Stories1 year ago

[STORY] THE PASTOR’S DAUGHTER (Complete Episodes)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories1 year ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 16)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories1 year ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 15)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories1 year ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 14)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories1 year ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 13)

Papa Loves His Girls by Opeyemi Ojerinde Akintunde_ANE Stories
ANE Stories1 year ago

[STORY] PAPA LOVES HIS GIRLS (Episode 12)

ANE Billboard Hots